LYRIC

 “‎If no be You”  Lyrics – Moses Bliss Ft. Festizie, Ebuka Songs, Chizie, Neeja, Doris Joseph, SON Music, Ajay Asika

‎[Chorus]

‎If no be You, where I for dey?
‎My life for end tay-tay
‎Baba, na You wey bring me out of shame
‎To You I give my all
When people fall my hand, You dey my side
When I no know wetin to do, You be my guide
Chai! I owe my life to You
‎Lord, I live to worship You

‎‎[Verse 1]

‎When I think of all You’ve done, I no fit talk am all
‎You no dey disappoint, na You dey pick me when I fall
‎If e no be for Your grace, if to say You no show face
‎My life for no make sense at all, I will praise You all my days

‎‎[Verse 2]

‎This life I live is a testimony
I’m grateful for Your grace that has kept me in this race
‎Oh Lord, You fill my life with goodness
Now all I see is sweetness
You’ve made my life a statement
‎In Your love, I am contented

‎‎[Verse 3]

‎Father of love, Your mercy sure
‎You no dey fail, I don see result
‎I must confess say Your word dey work
‎Daddy, Your word dey work, and e sure for us
‎You hold my hand, and show me the way
‎You no let me fall when my legs dey shake
‎Pillar of my life, I go sing Your praise
‎Since You touch my life, I no dey the same

‎‎[Verse 4]

‎I remember when suffer tie me like wrappa, been dey plenty palava
‎But the story never finish o, ’cause I get e God wey dey answer me o
‎Suddenly, You changed me, gave my life a meaning
‎Now I am counting my blessings every season o
Daddy, na You stand by me
‎When trials and challenges dem dey walk by me

‎‎[Verse 5]

‎Really and truly you’re my savior and my Father
‎There can never be another
‎You’re my shepherd, my provider (always)
‎You daily load me, You dey answer my prayer
‎You’re my Lord and my Master, no dey ever let me suffer (láyé)
‎I’ll keep on loving You, for You have been so good (ooh, ooh)
‎I pour my heart to You, for this Your love is true
‎If no be you

Added by

Just Gospel Lyrics

SHARE

Your email address will not be published. Required fields are marked *

ADVERTISEMENT